Uncategorized

Premier League fixtures for 2026-2027 season

Premier League trophy

Wia dis foto come from, Stuart MacFarlane/Arsenal FC via Getty Images

Di Premier League fixtures for di 2026-27 season go dey released on Friday at 9 AM GMT (10 AM WAT).

Di fixture announcement dey come one hour later dan di time dem dey release am for di past years.

Both di start and end date of di 2026-27 season also be later than di usual date sake of di 2026 World Cup.

Di new campaign go begin for Saturday, 22 August, 2026 – wey be 34 days afta di World Cup final for di United States.

Di Premier League season go now end on Sunday, 30 May, 2027, wit di Champions League final six days later.

Thirty three (33) rounds of weekend fixtures go dey for di new season, di remaining five games go happun for midweek.

Di Premier League tok say di next season schedule go dey designed to “avoid domestic competition clash wit Uefa competition dates, wherever possible”.

During di Christmas and New Year period, no two rounds of matches go happun within 60 hours of each oda, to keep up wit di commitment di clubs don make to deal wit di packed schedule during dat period.

Get in touch

Send us your questions

The Arsenal squad celebrate with the Premier League trophy

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Arsenal dey enta di 2026-27 Premier League season as defending champions

Major change to di international breaks

When di fixtures dey announced, one major tin go change for di schedule from late September and early October.

Traditionally, the opening months of the season have three two-week international breaks: one in September, one in October and one in November.

From next season onward, dis go change. November international break go continue as normal, but wit September and October, dem bin merge di two to become one long break.

Dis go mean say di Premier League season go dey three-week break afta di weekend of September 19/20 until October 10/11.

As tins dey now, di longer autumn break go continue until at least di 2030-31 season.

Source link

Visited 1 times, 1 visit(s) today

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *