Joe Biden plan to give US citizenship to undocumented immigrant spouses fail

Joe Biden plan to give US citizenship to undocumented immigrant spouses fail

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Biden administration fit appeal di ruling, but e come as Trump dey set to take office and don pledge to overhaul US immigration rules

  • Author, Madeline Halpert
  • Role, BBC News, New York

One federal judge don cancel President Joe Biden plan to give US citizenship to immigrants wey dia papers no complete wey dey married to American citizens.

US District Court Judge Campbell Barker, one appointee of Donald Trump, say Biden administration no get authority to establish di programme.

Di judge side wit one lawsuit wey 16 Republican-led states file wey argue say make Biden administration no bypass Congress to enact immigration legislation.

Judge Barker bin don already block di programme temporarily for hundreds of thousands of undocumented immigrants days afta e take effect for August.

White House react to ruling

Di White House for one statement tok say dem strongly disagree wit di ruling and dey evaluate dia next steps.

“Dis ruling side wit Republican state officials wey dey seek to force US citizens and dia families, pipo wey don live for United States for more dan ten years, to either separate or live for di shadows in constant fear of deportation,” White House tok-tok pesin Angelo Fernández Hernández tok.

“Our Administration believe in keeping American families togeda,” e add.

Di Department of Homeland Security say dem dey “deeply disappointed” by di ruling.

“We firmly believe Keeping Families Together dey grounded for well-established legal authority, and im purpose dey consistent wit fundamental American values.”

One group wey bin dey in support of President-elect Donald Trump, America First Legal, bin dey involved for di lawsuit against di plan, dem celebrate di ruling.

“Since day one, di Biden-Harris Administration don commit to yeye our immigration system and to erase our borders, “di executive director Gene Hamilton to.

Di Republican states “don succeed in stopping di illegal program wey for provide amnesty to hundreds of thousands of illegal aliens”, e add.

Di Keeping Families Together programme, wey Biden announce for August, na to allow undocumented immigrants wey dey married to US citizens and wey don live for di kontri for 10 years or more di possibility of getting a green card without leaving di US.

Afta three years, residents wit green cards wey dey married to US citizens go fit apply for citizenship.

Di Biden administration bin tok say about half a million undocumented immigrants bin dey eligible for di initiative.

E launch di plan just weeks afta e take actions to reduce di number of asylum claims for di US border, as di record number of crossings increase.

Di administration fit appeal Judge Barker ruling, but di appeal fit no make any changes as Donald Trump dey set to take ova di White House.

Di Republican president-elect don promise an overhaul of US immigration laws plus “mass deportations”.

Biden bin argue say di new plan go allow families to remain together, plus say di old system dey separate families.

Critics, meanwhile, claim say dem don offer amnesty for migrants we yenta di kontri illegally.

Source link

Visited 1 times, 1 visit(s) today

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *