Wia dis foto come from, Prince Williams/WireImage/Earl Gibson III/GG2025/Penske Media/Lyvans Boolaky/Getty Images
-
- Author, Faith Oshoko
- Role, Journalist
- Reporting from, Lagos
-
-
Read am in 5 mins
Dis year na good year for love.
From Nigeria Davido White wedding, di uniting of Tanzania and Nigeria and di couple wey bin wed for train.
For abroad, dem also see dia share of big weddings wey shake di world wen dem happun.
One of di world richest man Jeff Bezos run im second wedding for Venice for di middle of plenti protest and wit friends and celebrities.
Meanwhile two Disney alums and also Barney former child stars Selena Gomez and Demi Lovato run dia own weddings to di music industry bobos
BBC News Pidgin highlight some of una favourite celebrity love mata wey trend for 2025.
Temi Otedola and Mr Eazi (Love is Eazi)
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of Instagram post, 1
Actress and business woman wey dem bin dey call Temi Otedola becom Mrs Ajibade afta a three continent wedding to her musician and businessman bobo Tosin Ajibada aka Mr Eazi wey last from May to August 2025.
Dem bin run private court wedding for Monaco for 9 May, den two months later dem do di traditional wedding for Dubai for Temi papa Femi Otedola house for 5 July bifor dem kon end di whole waka for Iceland for August 2025.
Priscilla Ojo and Juma Jux
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of Instagram post, 2
For September 2024, social media influencer and actress Priscilla Ojo and her Tanzanian musician bobo Juma Jux bin reveal say dem don engage.
But e take till February 2025 for dem to start to dey run di wedding plans. Dis wedding too happun for two kontris and involve four events.
For Tanzania, dem bin run di Nikkah (wey be Muslim wedding) as well as dia civil ceremony.
And den dem enta Nigeria for April to run di White wedding (wey be for dia Christian wedding) and dia Yoruba traditional wedding.
Juma Jux also propose to im babe for evri venue wey dem run dia wedding and bin also reveal say e bin get plans to run dia wedding for wia dem bin first meet but di bride say she bin taya.
Davido and Chioma White wedding
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of Instagram post, 3
Following di Chivido wedding event wey loud for Lagos for June 2024, Nigerian musician Davido aka David Adeleke and im Chef wife, Chioma nee Rowland carry di mata enta Maimi for di White wedding part of di event.
Dem bin call di wedding wey bin happun for August 2025 ‘Lagos to Miami’.
Dis go be di last in three weddings wey dem don run. As according to Davido, di couple bin privately marry demsefs for di end of 2022.
Two tins of note wey happun for di wedding be say, both Chioma and Davido bin get mementoes of dia first pikin togeda, Ifeanyi afta im death just some weeks afta im third birthday. Chioma bin put im picture for wetin hold her bouqet togeda, while Davido use im picture as im cufflinks.
E also kickstart Chioma official comeback to social media afta almost three years away.
2baba and Honourable Natasha
Afrobeats, artiste 2Baba wey dey also known as Innocent Idibia bin marry one Edo state lawmaker Honourable Natasha for private traditional ceremony.
Although, official pictures of di wedding neva come out, di couple don already welcome dia first pikin togeda.
Shawn Faqua and Sharon
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of Instagram post, 4
Nigerian actor Shawn Faqua marry im babe Dr Sharon Ifunanya for Lagos for October.
But somtin wey catch pipo attention na wetin happun during di wedding. Di ceremony part of di wedding bin happun inside di Lagos Blue Line train wey send pipo for social media to go gaga wit how creative di wedding be.
Apart from dat, di traditional part of di day no carry last, as di content of women association meeting wey happun bin start to trend for social media.
Wia dis foto come from, Kevin Winter/he Hapa Blonde/GC Images/Getty Images
Jeff Bezos and Lauren Sanchez
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of Instagram post, 5
For June, one of di world richest men Jeff Bezos tie di knot wit im media personality long time babe Lauren Sanchez for di city of Venice as e shut down.
But di shut down no come from anytin like celebration for di happy couple but in protests from pipo wey dey vex wit ova tourism of di area and odas wey dey protest sake of climate change.
Selena Gomez and Benny Blanco
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of Instagram post, 6
American actress and music artiste, Selena Gomez marry her music producer bobo, Benny Blanco on 27 September.
Di wedding come two years into dia relationship wey dem don release joint album wey dem call “I said I Love You First…”
Selena Gomez first reveal am as her man for December 2023 afta about four-year-pause from dating. But she still reveal say dem bin dey date for six months till she publicly reveal am.
Demi Lovato and Jordan Lutes
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose ‘accept and continue’.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of Instagram post, 7
US Musician Demi Lovato also marry her musician bobo Jordan “Jutes” Lutes.
Di couple wey meet for January 2022, according to Vogue, run dia wedding for Santa Barbara on 25 May.
Charli XCX and George Daniel
Popstar Charli XCX marry her long time bobo wey be drummer for di band The 1975, George Daniel almost two years afta dem announce dia engagement for 2023.
Di Brat artist don dey wit dis her bobo and dem don collabo for more tins dan di oda room, as dem collabo for her hit 2024 album Brat wey dem credit di man say e follow write and follow produce two of di songs.
Hailee Steinfeld and Josh Allen
Sinners actress Hailee Steinfeld marry her NFL star bobo Josh Allen on 31 May for California.
Di couple bin don engage for November 2024 just four months afta dem meet for May 2024.