Wia dis foto come from, Getty Images
United Kingdom go stop di recruitment of care workers from overseas as part of one crackdown on visas for lower-skilled workers, di home secretary tell di BBC.
Yvette Cooper tok say “Time don reach to end care worker recruitment from abroad” and rules go change dis year – instead companies wey need care workers go employ domestically or extend di visas of overseas workers wey already dey UK.
Di goment plan to unveil series of changes to visa and recruitment laws on Monday, 12 May as part of efforts to cut net migration. Dem also say di measures go reduce lower-skilled workers wey wan come UK to 50,000 ova di next year.
Shadow Home secretary Chris Philp tok say di plans “too small” and e call for an annual cap on migration.
Wia dis foto come from, Getty Images
Successive goments don try in vain to reduce yearly migration, wey dey come di UK minus di number wey dey leave.
Net migration bin climb to a record 906,000 for June 2023, and last year e stand for 728,000.
Di Home Office neva officially confam wetin go dey inside di immigration White Paper, wey dem go reveal.
But speaking on BBC Sunday wit Laura Kuenssberg, Cooper say changes to skilled and care worker visas “go come in di course of dis year and those changes… dey expected to lead to a reduction of up to 50,000 fewer lower-skilled visas ova di course of di next year”.
She add say dem no go set targets for net migration, she say “dem dey undermine di credibility of anything wey goment dey do”.
Philp tok for di same programme say di Conservatives go push for a Parliament vote wey go fix annual cap on migration. Wen tori pipo ask wetin di cap go be, e say “we dey work on di detail to specify dat number”, but e go be “a further reduction wey go really pass more dan 50,000”.
Cooper also say “some changes” go dey to rules around international students and graduates.
“We go let dem kontinu to come and to stay and to work afterwards,” she add.
“We dey make some changes, particularly around di standards and di compliance for universities, bicos, again, we don get problems wia some universities bin no get proper standards in place.
“Dem approve pipo to come as international students wey neva complete dia courses, and dem don overstay dia visa or… other problems wit compliance of di system.”
Di goment don already tighten rules around care sector worker afta dem enta power last July.
Since 9 April, care providers wey wan employ new worker from overseas gatz first prove say dem do try to recruit worker from within England.
But di new rules wey go dey now go require care companies to recruit from domestic workers or from di pool of ova 10,000 care workers for UK wey get cancelled sponsorships bifor dem fit hire from abroad.
Alongside dis Cooper promise “to bring in a new fair pay agreement for care workers” to make care jobs more attractive to UK workers and reduce overseas demand.
Oda tins wey fit dey di Labour immigration crackdown?
Home Secretary Yvette Cooper dey ready to unveil di government new immigration rules wey go determine who fit come UK wit permission, and for how long.
Her White Paper, wey dem go call “Restoring Control Ova di Immigration System” na big moment for Labour to try to sort out a messy system, under which di number of pipo wey dey come di kontri rise way ova most pipo imagination.
Dis na tins wey fit dey inside di white paper.
Skills investment
Employers go need show say dem dey invest for UK skills bifor dem go allow dem bring in workers from overseas, di White Paper dey expected to say.
Labour don promise dis one for long, di IT and telecommunications sectors na di likely target.
Yvette Cooper last year bin promise to strengthen di Migration Advisory Committee so dem go fit “highlight key sectors where labour market failures mean there is over-reliance on international recruitment”.
English language tests
Di White Paper go likely include tougher English language requirements for immigrants.
But di Home Office don deny reports wey say di test for work visa applicants go be di same English as a foreign language A-Level.
At di moment, new arrivals dey required to demonstrate a basic understanding of English, equivalent to GCSE level, to dey eligible for certain work visas.
International care workers
Di immigration White Paper dey expected to highlight new rules wey come into force last month on di recruitment of international care workers.
Since 9 April, care providers wey wan recruit a new worker from overseas gatz first prove say dem don try to recruit a worker from within England.
Visa restrictions
Under di new plan, dem go restrict visa applications from nationalities wey dem reason say go wan overstay and claim asylum for di UK.
In practice, dis go mean tougher screening and more probing from officials for pipo wey dey come from kontris like Pakistan, Nigeria and Sri Lanka wey wan come UK to study or work.
Di Home Office for March mention three kontris as di biggest source of asylum seekers wey originally enta UK on a visa.
Permanent residence
Migrants wey already dey live for UK dey expected to wait longer bifor dem go fit apply for permanent residency, under di proposals.
At di moment, most pipo fit apply for indefinite leave to remain if dem don live and work for UK for five years.
Dem fit extend dis period to as long as 10 years for some migrants, according to reports.