Wia dis foto come from, SPUTNIK/KREMLIN POOL/EPA-EFE/REX/Shutterstock
Vladimir Putin don approve changes for di Russia nuclear doctrine wey don put for ground new conditions wia di kontri go reason to use dia arsenal.
Dem propose di update for September and na on Tuesday e rubber stamp am, on di 1,000th day of di war with Ukraine.
Dis dey also come afta Washington decision on Monday to allow Ukraine make dem fire long range US missiles enta Russia.
Wetin be di changes
Dis na di changes wey Russia make:
- Di doctrine now tok say attack from non-nuclear state wey nuclear power back go dey considered as joint assault for Russia.
- Large attacks on Russia wey use normal missiles, drones or aircrafts fit make dem respond wit nuclear response. Di attacks extend to ones against Belarus or any critical threat for Russia sovereignty.
- Any aggression wey come against Russia by state wey be member of a coalition go dey seen by Moscow as aggression from di whole group.
- Di updates bin expand di number of kontris and coalitions and di kain military threat wey go dey subject to possible nuclear response, according to di state run agency Tass.
Putin don threaten to use nuclear weapons bifor, and Ukraine yab di move say na “nuclear sabre-rattling” to make dia allies no give dem more support.
Di Kremlin ask oda countries make dem study di changes well-well as dem dey announce am.
Kremlin tok-tok pesin, Dmitry Peskov tok say, “dis na very important text, e suppose get very deep analysis”, according to state run agency Tass.
On Monday, Russia bin warn say dem go sama “appropriate and tangible” answer to US President Joe Biden on top im move to let Ukraine use di ATACMS missiles to strike di kontri.
One foreign statement tok say dat kain attack inside Russia territory “go mean say United States dey directly involved and dia satellites dey in hostilities against Russia”.
AP report say di new doctrine go dey published “in a a timely manner” according to wetin oga Peskov tok on Tuesday and say Putin bin request make dem update am earlier in di year so e go dey “in line wit wetin dey happun for ground now”.
Wetin don happun since di nuclear update announcement from Russia
Russia don announce say Ukraine don fire US supplied long range missiles enta di kontri. Dis dey come one day afta Washington bin give permission make dem run dat kain attacks.
Ukraine bin use di Army Tactical Missile System (ATACMS) for strike to di Russian Bryansk region dis morning, na wetin di ministry of defence for Moscow tok.
Five missiles bin dey shot down and one spoil. Di fragments bin cause fire for one military facility for di region, na wetin e tok for statement.
Di strike represent di first time wey dem don use long range missiles for Russia internationally recognized territory. Di attack come afta Washington bin give Ukraine signal say dem fit run am.
Wia dis foto come from, Getty Images
Ukraine don already use ATACMS for Russian occupied areas for dia territory for more dan a year.
Di missiles fit hit targets of range wey reach 300km and dey hard to block.
Kyiv now fit strike enta Russia deep wit di missiles. Di places wey dem fit hit include di Kursk region wia Ukraine forces hold ova 1,000 sq of territory. Ukraine and US officials dey reportedly expect counter offensive for di region.
For statement, Russia defence ministry tok say dem attack dem by 03:25 (00:25 GMT).
E say di fire wey one of di particles from di missiles bin start bin sharparly dey turned off and no bodi die.
Ukraine military bin confam bifor say dem sama one ammunition warehouse for di Russian region of Bryansk, but dem no tok weda na ATACMS dem use.
Dem say di attack on one depot wey dey about 100km from di border near di town of Karachev bin cause 12 oda explosions.